ENTERTAINMENT, Family Life, Relationship, SECURITY, SEX, Southerner Xtra, Trending with Nancy Mbaegbu

2Baba beats own record, scores first goal with Natasha By Nancy Mbaegbu

Southerner Xtra -Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, November 30, 2025

 

Wonders shall never finish for this our entertainment highway oo! As everybody still dey sip tea from old celebrity wahala, another premium gist just land like overnight delivery wey nobody order.

My loves, 2Baba don add fresh chapter to him legendary “men are doing too much” curriculum and this time, na baby boy with Edo lawmaker Natasha Osawaru.

Early Friday morning, when innocent Nigerians still dey struggle with alarm snooze, Internet people don already dey speculate say madam Natasha don enter maternity mode. Person see am for hospital, and next thing, gist don circulate everywhere like party flyers.

2Baba, Natasha welcomes first child together - P.M. News

But Natasha no waste time, she come out herself, drop announcement on Facebook with full joy, say she and 2Baba don welcome bouncing baby boy. As she post am like that, congratulations begin rain for social media like say dem open sky tap.

And if you think say na ordinary announcement, you dey joke. This baby no just be child; e be certified sequel to their relationship wey Nigerians don use binocular follow since February.

Because ever since 2Baba propose on Valentine’s Eve, people never rest. From family introductions to traditional rites, every step na another national discussion. Nigeria no dey carry love matter play at all.

Una remember say na January 2Baba and Annie go their separate ways. Since that time, public eye hook for these two like stubborn chewing gum.

Everywhere you turn; Instagram oo, WhatsApp status, even your colleague wey no mind him business, everybody get opinion. But love no dey fear noise; the two carry their matter with steady chest.

Fast forward to July. Dem host one coded traditional wedding for Abuja. Very low-key, strictly VIP-family-kind-of-affair; no crowd, no paparazzi, no people wey go use the wedding rice snap picture for status. Just love, culture and quiet blessing. But trust Nigerians, even low-key gist go still leak small.

Now baby don land, and the congratulations wey dey fly up and down sweet pass fresh ram suya. People dey comment things like, “Congratulations to them,” “God bless the new family,” “This child will bring joy that pass government promise.” Nigerians must add ginger.

As e be like this, new chapter don open. Whether you dey support dem or you just dey observe from corner, 2Baba don add one more star to him fatherhood constellation and Natasha don enter motherhood hall of fame.

Pastor Adefarasin drops national security warning

Pastor Paul Adefarasin issues war-readiness plea amid security threat - ValidUpdates

Just when Nigerians dey try enjoy small peace and quiet from all the countless drama November carry come, Pastor Paul Adefarasin waka enter pulpit with calm face drop one sermon wey turn social media upside down again.

Him talk say, “I dey pray say Nigeria no go ever reach war, but if e reach, I ready for am.” Omo, as him talk, people dey flash back to that “gun-for-traffic” video, dey laugh small, dey whisper, “Omo, this man no dey joke oo!” Na so pastor take remind people say dem fit carry gun one day.

Pastor Adefarasin no stop there oo. Him hope people go embrace peace, dialogue, and better understanding first, but omo, the pastor say him no go carry last for reality. According to am, Nigeria no fit sleep like baby because terrorism and extremist wahala dey spread across Africa, and Nigeria be one of the frontline countries.

Adefarasin add say diplomacy dey, but make country get intelligence, strategy, and muscle to handle those wey dey try shake am.

Then he remind us about wahala for Middle Belt and North East. According to am, some powerful people dey behind efforts to push locals out, dey extract resources illegally, and dey fund the killings well. Pastor ginger everybody say dem no dey work alone, say network dey support am. Omo, na heavy gbege oo.

He come dey call all Nigeria’s bright minds; thinkers, strategists, technocrats, intellectuals from all tribes to join hands. Him warn say if dem no do am, Nigeria fit enter war wey dem no ready for.

Him end the sermon with serious prayer for unity, vigilance, protection, and wisdom, and hope say war no go happen, even though him personally ready if gbese reach that level.

By the time sermon finish, social media don dey bubble. People dey laugh, dey sigh, dey ginger small. Pastor don remind everybody say Nigeria must dey ready, but still dey pray and hope for peace.

 

Scandal hits paystack: Ezra Olubi’s mad twitter past

Ezra Olubi: Paystack co-founder wedding attire spark twitter reactions - BBC News Pidgin

Omo, una no go believe wetin just burst out for tech world. This Paystack‑Ezra gist hot like fresh pot of soup. Just when Paystack dey shine as fintech big boy, one heavy scandal just land, scatter the whole place.

Paystack hit the headlines with shocker. Ezra Olubi, co-founder and CTO, has been fired. Next thing, Ezra come out talk say dem terminate his contract before the internal investigation even finish.

According to him, no meeting, no chance to explain himself, nothing at all. E be like alarm wey dey shout fraud, but nobody even give am chance to speak. Now him lawyers dey check every paper to see if Paystack followed their own procedure.

The wahala first blow when social media post accuse Ezra of misconduct with a junior staff. But omo, the real mad matter na the old tweets. People dig up tweets wey Ezra post between 2009 and 2013, and omo, some of them na serious gbege wey fit make person frown small.

Jokes about erections during meetings, sexualised comments about colleagues, even anime references wey dey highly inappropriate. One tweet boldly talk say: “Monday go dey fun with an ‘a’ in it. Touch a coworker today. Inappropriately.”

As these tweets trend, Nigerians no hold back. Some dey call am predatory behaviour, others dey call for accountability. Some dey shake head dey mutter say, “Those tweets? My brain dey leak small small.” Others dey observe the scandal unfold and dey sigh.

And of course, some dey remind everybody about fairness. The pressure just dey grow like NEPA bill for December, and e clear say this wahala no be small thing.

Paystack, wey Stripe acquire in 2020, still never release official comment after Ezra blog post. People dey wait to see if parent company go talk or if legal wahala go follow am.

Ezra himself dey consider next moves, including possible court action, and people dey ginger because if law waka enter, e fit open plenty hidden doors about how tech companies dey handle misconduct.

As usual, i dey sip tea dey observe for update make I fit come gist my Aprokonation. But abeg before una post anything online, make una think am well oo cos the internet never forgets.

May be a graphic of text that says 'SauthernerXtra vol 1,No 130 โดษงนะัขขรุณเท์่น่ลนล้ Website: www.thesoutherner.com.ng The authentic voice of the people Sunday, November 30, 2025 But Natasha no waste time, she TRENDING come out herself, drop announce- ment on Facebook with full joy, say wオん she and 2Babo don welcome bouncing aηc4 TBaeApи baby boy. As she post am like that, con- gratulations begin rain for social nancymbaegbu@yahoo.com media like say dem open sky tap. 2Baba beats own record, scores first goal with Natasha BET for រាជាីបក្រូ Lirculate varning Deran LAGOS OFFICE OFFICE: Emnany's Chiet well AHousing Estates, DBS Road:'

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Click to listen highlighted text!