ENTERTAINMENT, Family Life, Heart Matters, NATIONAL, News, Relationship, SEX, South South, Trending with Nancy Mbaegbu

Chimamanda’s tragic loss, rot in a system by Nancy Mbaegbu

Southerner Xtra -Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, January 18, 2025

 

My people, just when everybody dey expect 2026 to start soft and calm, Nigerian literary icon Chimamanda Ngozi Adichie hit social media with wahala wey cut deep. No be book release or viral quote this time—na real-life heartbreak.

If you don read book wey make you feel smart pass yourself, then you sabi Chimamanda Ngozi Adichie; Nigerian author, global literary icon, and outspoken commentator wey books like “Americanah” and “We Should All Be Feminists” don win awards and spark worldwide conversation. But last week, na grief take over the spotlight.

Chimamanda's tragic loss - The Nation Newspaper

For emotional public statement, Adichie reveal say her 21-month-old son, Nkanu, tragically died after medical wahala for Euracare Hospital, Lagos on January 6. The news scatter online. People start to dey drop condolences, dey ask questions. Emotions full everywhere.

According to Adichie, dem dey Lagos for Christmas when small cold wey Nkanu get begin turn serious infection. Dem admit am for Atlantis Hospital, and plan to fly am to Johns Hopkins Hospital for United States of America where team of doctors dey ready to receive am.

For preparation, dem need to do MRI, lumbar puncture, and insert central line, but Atlantis refer dem go Euracare.

For January 6 morning, Nkanu enter theatre for Euracare. Dem give am propofol sedation to calm the pikin for MRI procedure.

Chimamanda say she notice as staff dey rush enter theatre. Her gut feeling tell her say something no pure. Later she hear say dem give the child too much propofol, e no respond, dem try to resuscitate am, but e no work.

Omo, after that wahala, dem intubate Nkanu, put for ventilator, carry am enter ICU. Next thing, the pikin begin get seizures, heart dey waka funny. Then cardiac arrest show face; na so pikin take pass away few hours later. The matter dey heavy, e dey painful, and e dey show say even for hospital wey dem trust, mistake fit cost life.

Adichie talk say anesthesiologist actions na “criminal negligent and carelessness”. She even claim say the same doctor don overdose other children before, yet him still dey work.

Her sister-in-law, Dr. Anthea Nwandu, yan for Arise TV say the hospital medical director actually admit the overdose, wey reportedly cause brain injury and cardiac arrest less than 24 hours after dem carry Nkanu enter hospital. She also add say the anesthesiologist carry the small boy wey no dey respond waka go theatre without proper oxygen support.

The story explode social media worldwide; fans, medical experts, activists start to dey share grief, dey ask questions, dey drop condolences, dey shout “how this one happen?”.

Lagos State Government don extend condolence, while Governor Babajide Sanwo-Olu order HEFAMAA make dem run immediate investigation with Medical and Dental Council of Nigeria. And Officials don promise say everything go transparent, and anybody wey dey for fault go face full weight of the law.

Even for person wey dey use words dey command world attention, this wahala don turn serious plea for accountability and reform, wey dey resonate well beyond Nigeria.

The tragedy show say even big literary icons no dey immuned to life wahala wey cut deep like this one. Rest in peace, Nkanu. Everybody feel the grief and their hearts dey go out to Chimamanda Ngozi Adichie and her family during this painful time.

Love on trial in Akwa Ibom

My people, this one no be rumour wey pass ear casually, na full-blown town crier alarm. The kind wey make you pause mid-scroll and check who offend who. This gist land like court summons: unexpected, unavoidable, and slightly threatening.

Akwa Ibom lawmakers don drop proposal wey make romance begin pass handshake wey pass shoulder.

According to the so-called bill warming seat for House plenary, any unmarried woman wey enter consensual understanding and entanglement with a married man fit secure ten years behind bars. Ten. Complete decade. No appeal, no alternative punishment, just iron gate and long conversation with prison calendar.

Now, breathe small, because here comes the part wey scatter balance. The married man involved no dey share same destiny. His own punishment? ₦2 million fine. That’s all. Pay, dust hand, continue life.

As one online observer yarn am, “So na subscription plan be this? One person dey do time, the other dey do transfer.” The maths no pure at all.

The imbalance taste like bitter leaf; sharp, confusing, and hard to swallow. Love suddenly wear handcuffs, but only for one wrist.

Accountability shift direction like compass wey don lose North. Romance, wey suppose be private misjudgment, don upgrade to state offence—selectively.

The bill allegedly sponsored by the Deputy Governor Senator (Dr.) Akon Etim Eyakenyi, no even try form gentle. Any “young girl, lady, or woman” wey cross that invisible marital boundary don offend the state.

Meanwhile, the married man; full-grown adult with ring, vows, and responsibility go simply open app, tap-tap, and continue his evening. One person enter history books, the other collect debit.

Social media no dull. One commentator ask, “So temptation don get gender now?” Another conclude sharply, “This one na premium protection plan for married men.” The sarcasm pour like cold water for hot afternoon, refreshing but pointed.

Wetin make the gist sweeter na the confidence behind the punishment. Mandatory ten years. No option of fine. No option of mercy. People don begin ask the questions wey lawmakers no touch yet: how dem wan enforce am? Spy neighbours? Relationship whistleblowers? Or emotional surveillance unit?

But just as the debate dey gather momentum, the table turn. The Akwa Ibom State House of Assembly come out clear to say no such bill dey before them at all. According to the Assembly, the story no get legislative backing and never reach House floor.

To add to that, the Office of the Deputy Governor also debunk the claim, describing the bill as non-existent and distancing Senator Akon Eyakenyi completely from the matter. They even clarify say under Akwa Ibom’s system, the Deputy Governor no dey sponsor bills in the first place, so the whole thing na gist wey grow wings.

So as it stand, there is no bill, no proposal, and nothing scheduled for passage. But the reaction alone don already expose deep questions Nigerians dey ask about morality, gender balance, and how easily punishment dey get assigned.

In the end, even though this particular law turn out to be audio bill, the conversation wey e spark real pass real. The speed wey people believe am and the anger wey follow, show say the issue don dey boil quietly. And for Akwa Ibom, dem don spark national conversation wey no go cool anytime soon.

Kano’s scissors surgery tragedy

Wetin dey even happen for this country sef? Sometimes you go just dey wonder if some people attend medical school or na crash course dem do with prayer and vibes. Because explain to me like I be five years how person enter theatre, open body, do surgery, close am and still forget metal equipment inside human being?. This Kano gist wey surface this week no even get sense of humour. E just dey slap brain left, right, centre.

Madam Aishatu Umar do surgery for Abubakar Imam Urology Centre around September 2025. Surgery finish, everybody smile, patient waka go house. But almost immediately, her body begin talk another language.

Madam begin complain of serious belly pain; persistent, stubborn, the kind pain wey no dey respect painkiller. She waka go hospital again. And again. And again. Each time, dem give am drug tell her say na normal post-surgery pain. No scan. No deep check. Just vibes, tablets, and crossed fingers.

Four months pass like this. Pain refuse to relocate. Na when body don almost cry blood, she enter another hospital, Muhammad Abdullahi Wase Specialist Hospital and later Aminu Kano Teaching Hospital. Na there scan show say pair of surgical scissors dey inside her abdomen like dem forget am during house cleaning. At that point, even silence get headache.

Plans was made for corrective surgery to remove the unwanted souvenir. Family dey hope. Children dey wait. But before the operation fit even start, Aishatu, mother of five pass away early Monday morning. Just like that, no long story. Just pain, then goodbye. Suddenly, everybody remember say life no dey get undo button.

Social media catch fire as usual. One online comment wey pain pass say, “Na hospital she go for help, na there problem multiply.” One auntie online even drop: “If na mechanic forget spanner for engine, customer go scatter shop. For human body now nko?” Silence. No answer.

As public begin shout, Kano State Hospitals Management Board come out sharply. This time, dem no dodge. Investigation confirm say negligence truly happen. Scissors was truly left inside patient body. Three medical personnel wey dey involved don face suspension sharp sharp, and matter don move enter medical ethics committee for full examination.

As we dey talk now, family dey mourn, public dey vex, and trust don collect serious injury. This no be just one family problem; na system matter. When hospital begin treat patient complaint like background noise, na there danger dey hide. Everybody dey ask the same question in different accent: who go protect patients if caregivers dey careless? Because if scissors fit sleep inside person body for months, then all of us dey one admission away from premium heartbreak.

May be a graphic of text that says 'SouthernerXtra Xtra Farcbmiww/wnrtos.o/isulerw Frrebook Website: ewww.thesoutherner.com.ng vol 1,No1 147 The authentic voice of the people Sunday, January 18, 2025 Her sister-in-law, Dr. Anthea Nwandu, TRENDING yanf Arise Vsay the hospitalı medical actually overdose, wey reportedly cause brain injury cardiac wえオん less than hours after dem Nkanu enter hospital She also add say the Nancy Mbaegbu carry smal we no waka theatre without nancymbaegbu@yahoo.com proper xyAe support. Chimamanda's tragic loss, pool scissors The OFFICE Whatsapp onty) ,Lokogoma:'

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Click to listen highlighted text!