AFRICA, EDUCATION, Frontrow, HISTORY, NATIONAL, POLITICS

Crisis of Nigerian Citizenship (Pidgin Slam Version By Pius Mordi) By the spirit of Plato, for the heart of Naija

(Put into pidgin by Amaka Ejiofor)

Intro –
Dem say Plato talk am for old Greece —
Say to be citizen no be only chop and enjoy breeze.
E mean say you go carry matter for head, no bi moi moi.
Stand for justice, no dey pretend like say you dead.

Verse 1 –
Citizenship na work, no be just name we dey bear,
No be to dey shout “I be Naija” when food land near.
You suppose fight when tins no clear,
Speak truth even if fear dey tear your wear.

When law dey oppress and rulers no dey hear,
Plato talk say make we rise, make we no just dey cheer.

Verse 2 – Mohamed Bouazizi
See that guy Bouazizi for Tunisia,
Police wahala don break him criteria.
Dem harass am, dem oppress,
One day e pour fuel, set himself ablaze — no rest.

From that fire, revolution rise,
Governments fall, people open eye.

Verse 3 ––
For Naija, we sef get warriors wey no fear,
Gani Fawehinmi, real Gani dey always dare.
Court case plenty like sand,
But him no dey chase money, him dey defend the land no bi di kindly one adeyunju & co dey do wuruwuru activism.

Him show say to be citizen na fight,
No be just to chop jollof rice every Friday night.
E mean to talk true even when e pain,
To challenge government, tear the chain.

Verse 4 –
But now, na different citizens dey loud pass,
Dem no dey hungry, dem dey collect pass.
Social media full of paid voice,
Wey go tell you say suffer na your choice.

Dem dey shout, “Tinubu dey try!”
Meanwhile mama for market dey cry.

N70,000 dey make noise,
But wetin Naira fit buy na just small rice.

Verse 5 –
Any small complain, dem go call you saboteur,
Say na you wan scatter Naija for tour.
Criticize government? Dem go tag you enemy, as dey Dem tag obi & obidients. But bayo onanuga go come dey run him mouth. Wike dey for one side dey talk rubbish, say na politics, Oga olokpa dem no go talk.)
Forget say na your right as citizen, no be felony.

Abuja don train new citizens wey dey hail,
Wey go use grammar kill truth, no dey fail.
Na dem government dey like to hear,
Dem go package lie, serve with beer.

Verse 6 –
So who be citizen for Naija today?
Na who sabi clap when government say.
Who dey smile when pikin no go school,
Who go dance even if dem treat am like fool.

Plato for grave go dey reason this kain matter,
If him wake now, e go tear him charter.
‘Cause wetin him call “burden of citizen”
Don turn to “silence and follow like chicken.”
Even for our aniocha lga, UDC, we own town Ubulu, once you talk pia say you no like as de government dey do us, hungry attack foot soldiers go abuse you tire.
Na real wahala we dey see —
Na crisis of citizenship… for we country.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Click to listen highlighted text!