ENTERTAINMENT, Family Life, Health, HEALTH AND WELLBEING, Heartbreak, News, Relationship, SEX, Trending with Nancy Mbaegbu

High drama as 2Baba cries for help by Nancy Mbaegbu

Southerner Xtra  -Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, December 7, 2025

 

Happy new month my people. The gist wey land hot pass hot akara! One resurfaced video of Natasha Osawaru, 2Baba’s latest queen, confronting him inside a London airport shop don turn Naija Internet to open stadium. Even airport AC freeze small when the wahala start.

Natasha claim say the matter start when Baba waka ahead with fans without her, plus she talk say Baba dey give one promoter unnecessary attention. But as Baba dey try explain, madam no gree hear word. The London saga no stop there oo, police even handcuff 2Baba for the clip wey trend online.

2Face Idibia Breaks Silence on Viral “Cry for Help” Post

But my people, this airport gbege na just appetizer. The main dish dey red. Rumour dey fly say the couple recently welcomed their first baby together but the whispers get wings. People dey allege say aunty still dey take drugs during pregnancy, and that na why the baby arrive premature. Omo, the tea get ice block inside.

Next thing, 2Baba drop one social media post : “Help me.” People nearly faint. But Funnybone quick jump in, calm everybody say Baba phone dey hacked, no be actual meltdown.

As if that no loud enough, ex-manager Kaka Igbokwe confirm say everything for the video na true life. Kaka no use filter for Daddy Freeze live session. Him add say Natasha dey controlling, violent, and dey manage Baba finances. UK tour, African stadium shows, and government-backed gigs almost collapse under her “cancel am” orders.

Even 2Baba join Instagram Live try to defend himself, but background shouting allegedly from madam make am cut the broadcast sharp-sharp. Management dey talk say Baba don turn house husband now, dey collect mouthfuls of stress every day. Fans dey yarn online: “Omo, this one don enter premium drama level!”

But the one wey nearly make my jaw relocate be when gist drop say Natasha Idibia dey operate Baba phone like personal ATM machine. Sis allegedly dey message 2Baba friends for cash, pretending say na him dey request small financial support then drop her own account number with boldness.

As the alert land, she go quietly delete every evidence like digital magician. And the worst part? People talk say the money dey go straight into substances, no be baby food or family upkeep.

If you think say the gist don end, abeg sit well. Their domestic staff claim say once house dry of drugs, Natasha fit enter full chaos mode; beat staff, burn people clothes, tear passports, scatter everywhere.
According to the people wey dey yarn this thing, the drama sometimes dey loud, even calm 2Baba go just siddon like person wey life don tire.

But just as Internet dey vibrate with heated opinions, 2Baba finally break silence. In a fresh video he begged everybody to calm down, stop the dangerous rumours, and cease fire. Him talk say the matter don escalate reach level wey fit put Natasha at risk, and fans dey push narratives wey no follow.

Baba insist say him dey fine, say him no type any alarming post, and beg friends, fans & family to stop the panic. Shebi una see why dem dey warn say no put mouth for husband and wife matter?

Las las, person wey carry ant-infested firewood enter house no suppose shock when lizard begin hold meeting for parlour. 2Baba chose this woman with all the full package and bonus drama join.

 

Dog meat saga in Akwa Ibom

May be an image of text that says 'ABELEKPO-UFOT'

Every state get wetin dey worry them true true, and Akwa Ibom no be exception. But nobody prepare for the day wey their Honourable House of Assembly go gather, sit down majestically to decide the destiny of dog meat. Yes, that same delicacy wey some people guard like family treasure.

Honourable Uduak Ekpoufot waka enter chamber with courage wey fit wake ancestors. The man arrived with PowerPoint voice, begin talk diseases, hygiene, spiritual danger, emotional trauma; the full science and practical. But before him even clear throat finish, motion don hang because nobody gree second am. Chamber quiet sotey you fit hear mosquito doing rehearsal.

Honourable look left no volunteer. Look right everybody don suddenly develop deep interest in their table. E be like say him colleagues dey scream inside their mind, “My brother abeg no drag us for this one, we still dey find rice money.” Motion expire on arrival. Zero debate. Na that time dog meat lovers begin smile like people wey win lottery.

Outside parliament, Akwa Ibom Internet people start their own parliamentary sitting. Some dey shout, “How this one take be our priority? Road bend, salaries limp, economy dey pant, but na dog chop you dey chase?”

Others dey jubilate like person wey escape exam: “Heritage secured! National protein protected!” Even people from other states join the gist, drop comments like pepper: “Una dey stress dog for nothing, abeg leave people to enjoy their evening ritual.”

Experts come out too with big grammar. Dem say even if government ban am, enforcement go tough pass convincing Nigerian man to throw away old singlet. For places wey believe say dog meat dey cure joints, boost morale, and give body glow, you no fit just drop ban like threat. People go still chop am codedly.

Although many countries don ban am; US, UK, Germany, Taiwan, South Korea but dog meat loyalists for Naija no send. Dem dey argue say every meat get pros and cons if you handle am well. Meanwhile, animal lovers dey hold chest say cruelty too much.

At the end, Akwa Ibom lawmakers don seal am: dog meat must breathe. And as dem dey always talk, if you like carry stick enter people’s kitchen, just know say na you go chop insult last.

 

HIV don tie scarf for Lagos

Lagos govt targets 11,000 for HIV impact survey – Tribune Online

Make we leave gist small talk real matter my Aprokonation. I know say some of una don dey iron outfit for owambe party season like say na wedding invite una receive. But before you tie scarf for enjoyment mode, abeg make we hold small family meeting.

HIV no dey observe holiday oo. While you dey plan matching pyjamas, boat cruise, and soft life, the thing still dey waka round town like overfed landlord wey no dey pay rent but dey oppress tenants.

Before you raise eyebrow, Lagos don knack us another wake-up call: 160,000 people dey live with HIV for just one state. Last week alone, dem test over 9,000 people and 2% come out positive. Meaning say for any party wey you dey dance with full chest, at least two people for every 100 fit carry the virus and no even sabi. No be intimidation, na awareness.

Testing sef don slow down because some international ogas freeze their support like person wey dey do silent treatment. But LASCA still dey push testing, sensitization, treatment and the ones wey test positive don enter care sharp-sharp. At least sense still dey the system.

But make we yarn truth: young people dey collect HIV like free souvenir. Why? Lack of testing, risky moves, misinformation, and that dangerous “God forbid” confidence. Abeg, confidence no be prevention method. If you like shout “it can’t be me” from now till crossover night, biology no dey hear mood swing.

We never even digest the Lagos statistics finish, dem don drop one emergency wahala. One popular influencer collapse live on video after her test show positive. Madam claim say her baba talk say na spiritual attack from jealous friends. Na when hospital run real test, truth appear like sunrise. she begin shout, “Jesus, who did I offend?” Internet scatter, everybody turn emergency motivational speaker.

We never even breathe well, Abuja waka come carry him own confusion. One herbal doctor carry ring light do video, claim say him don cure over 500 HIV patients with leaves wey resemble water dem use rinse bitterleaf. People rush the place like crusade.

Before we blink, NAFDAC land vex, seal the place, and ask Oga miracle-worker to explain before person go drink infection in the name of healing. Two of the ‘cured’ patients later confess say dem never do proper confirmatory tests; faith and vibes na their diagnostic tool. Abuja people sef!

But calm down, Aprokonation, science don land with hot solution wey go reduce all the drama wey dey embarrass destiny.

New HIV-prevention injection don show face. The name na PrEP (Pre-Exposure Prophylaxis) injection. And this one strong no be here; Twice a year only, and e dey prevent HIV with over 99.9% assurance. If you take am well, HIV no go even smell your shadow.

South Africa, Zambia and Eswatini don start rollout already. Abroad, the price dey bite like Ikoyi rent ($28k per year), but Africa go soon dey get am around $40 by 2027. God bless Unitaid for negotiating before person begin cry like orphan.

So as you dey package yourself for December groove, ask yourself: how you wan protect yourself before 2026 waka enter with story wey bend leg?

Use condom like responsible adult. Know your status. No share needles. If you suspect any risky encounter, run go take PEP (Post-Exposure Prophylaxis) medicine within 72 hours. And if test ever show positive, calm down. HIV no be end-of-life soundtrack again. Treatment dey. Life still full ground.

And I must shout this again: HIV no dey show for face. All those fine boys wey resemble skincare adverts, and all those slay queens wey dey glow; anybody fit carry am unknowingly. Only TEST go show reality. Not vibes. Not instinct. Not “I trust him.” Not “she clean die.”

If you know say your December waka go hot, abeg carry safety like helmet. No let detty December dirty you.

May be a graphic of text that says 'SmuthernerXtra vol 1,No 132 Forbonb-we/enitoco/isuew Website: www.thesoutherner.com.ng outherner Xtra The authentic voice of the Sunday, December 7, 2025 Asi that loud enough, ex-manager Kaka TRENDING Igbokwe confirm say everything for the video true life. Kaka use filter Daddy Freeze session. add say Natasha dey witん controlling, violent, manage Nancy Mbaegbu African stadium shows, and government-backedgi collapse nancymbaegbu@yahoo.com under her "cancel orders. High drama as 2Baba cries Acsoenn help Ta meat Akwa know& มร เวม publication LAGOS OFFICE: เพชโลผยง for Lagos උේ්කක kmulmatter BOOMS ASABAC Resides Hlousing Estates DBS Road:'

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Click to listen highlighted text!