Southerner Xtra —Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, September 7, 2025
My tori lovers, na new dispensation don land inside Deeper Life o. Pastor Kumuyi himself don shock the congregation with update wey sweet like suya and still hot like moi moi.

Forget all those iron rules of the past: no visiting, no crossing leg, no see-your-bae’s compound till wedding night. Baba Kumuyi don reason am well and say, “Why not, if not? Follow them home!”
E shock you? E shock me too. For years, Deeper Life babes dey complain say courtship be like blind audition. Six months, you just dey pray and dey decode the man from afar.
Bros go dey smile like statue, answer every question with “it is well” and “everything is okay,” meanwhile his mama fit be landlord wey no dey like tenants, and his papa fit dey measure toothpaste for house. Ladies come talk say, “Oga Pastor, abeg, this thing no balance.”
And guess what? Pastor Kumuyi gree! Him talk say this six-month restriction no be Bible verse, na just administrative measure to keep wahala away. But marriage no be small project, na forever contract wey fit determine person destiny.
So as a sharp man, him don adjust the rules. Now, ladies fit waka go bros’ family house, check the environment, smell the soup, see the family wahala, and even confirm if bros dey form gentle when in fact him fit be Commander-in-Chief of stinginess.
Imagine am: sister go visit and discover say bros dey claim Mr Perfect but in reality, him dey ration WiFi, dey lock fridge with padlock, and dey dodge NEPA bill. Una know wetin I mean. Pastor say, no be to do FBI investigation o, but to simply see how bros dey handle his people and if him environment go swallow you alive.
But abeg, papa also add small disclaimer: “My children, abeg no use this opportunity do anyhow. No late-night waka, no rubbish behavior. I trust your maturity.” Him mean say make una no go turn “follow them home” into follow them under blanket.
So ladies, the floor is open! The days of guessing game don finish. If bros dey play silent chess with your destiny, abeg collect your handbag, waka go meet his people, see how dem dey chew meat and wash plate. Because as Pastor don talk, why not, if not?
Ruth’s Death: Condolences, confessions, and confusion

My gistlovers, this tori wey land for our table send chills down person body ooo. Shebi una remember Ruth, Phyna’s younger sister wey Dangote truck jam for Auchi some weeks back? The same fresh graduate wey just finish school six days before the accident?
Sadly, my people, the painful news don confirm say Ruth don kpai. She gave up the fight in the early hours of last Sunday morning, and just like that, a promising life don end.
As condolences still dey flow in for the family, typical Nigerians no gree mourn in peace. Instead of silent prayers, na hot takes full everywhere. Some dey console Phyna, others dey drag Dangote Group say their trucks don turn road menace.
And before we fit even balance, Ruth’s alleged partner burst out with confession wey scatter everywhere like Christmas fireworks.
According to the man, na him carry Ruth matter for head for the past three years; paying school fees, feeding her, looking after the son she get before, plus the one wey dem born together. Phyna? Him talk say na only gown and wig she send two months before graduation.
As if that shade no dey enough, the man add challenge: “If Phyna show proof say she sent money in three years, I go bow my head in shame.” Omo, Nigerians nearly break internet.
Dangote Group sef no dey left behind. Dem release statement say dem dey deeply sorry, even claim say na dem dey foot her bills since and don already dey arrange medical trip to India for Ruth before death spoil the plan.
But Nigerians no gree buy am, dem still dey drag them like mad because this thing don dey happen too many times, and e too dey painful, especially as Ruth leave behind small children. The dragging no be here.
Dangote never open mouth again since the press release, and the government? Silent like Sunday morning—nobody talk. Meanwhile, her family don confirm the sad news officially, but Phyna herself never drop any public word since the announcement.
So now, the matter don split into three: condolence givers wey dey genuinely cry, Ruth’s partner wey dey call Phyna out, and angry Nigerians wey no dey forgive Dangote Group. Na so Ruth’s death turn from tragedy to full-blown national gist.
But beneath the dragging, shades, and blame game, one fact still remain, a young woman wey suppose dey enjoy her fresh graduate life don go just like that. Forget the noise, this one truly dey sad. May Ruth’s soul rest in peace.
The plate that broke an engagement

My people, make una gather here o, because this gist, ear wey hear am go choke. Una know say love sweet but sometimes na small thing go just scatter everything like breeze wet blow wrapper. This gist na about one small washing plate matter wey scatter wedding plans like puff-puff inside hot oil.
So the aproko be say, one fine bobo carry himself go do “family courtesy visit” for him babe wey em wan marry put for house. You know, to go show respect and confirm say him ready to join the family.
Na so Bobo waka enter, expecting warm smiles, maybe jollof rice, and small “you’re welcome, our in-law.” But instead, the thing wey greet him eyes nearly make am faint.
Na the babe papa him see, bend for sink, dey wash plates like say dem employ am as kitchen boy. As if that one no pain reach, the mama of the house stand one side with folded arms, dey shout: “Be fast na! Rinse am well!” My loves, the guy eye nearly pop out.
Inside him mind he begin calculate: If papa wey be senior dey obey like houseboy, wetin go remain for me when I enter? Na apron dem go tie for my neck too? The thing weak am. Love suddenly turn to mathematics wey no add up.
Before anybody go say “enjoy your visit,” the guy don already dey reason escape plan. Na so him sharply return to his base and announce, “This marriage no go hold again.” Engagement ring? Cancelled. Wedding date? Deleted. Pre-wedding pictures? E go remain for memory card dey gather dust.
Internet people come turn judge and jury. Some dey argue say house chores no kill anybody, others dey hail the guy for sharp eye wey him take see tomorrow before e land. Some even say the man run because him don see trailer of the family drama wey dey come.
After all, who wan buy suya with full chest when goat wey born am dey cry in the background? if papa wey suppose dey chill like elder statesman dey carry sponge, wetin remain for son-in-law?
No be about the plate wey the man dey wash, na the handwriting on the wall wey person read clearly. Love sweet, but nobody wan collect kitchen duty as inheritance. Abeg, would you cancel wedding over washing plate prophecy or you go just hold sponge and continue?
Visa wahala reloaded

E bi like every day Nigeria dey serve us fresh wahala buffet, and this latest one sweet and bitter at the same time. Imagine packing your bags, ironing your finest travel outfit, ready to go “enjoy small japa breeze,” only for Uncle Sam to say “Oya bring that passport make I collect my visa back.” Just like that o. Your dream waka turn to dream waka-pass.
According to reports, U.S. embassy don start one silent operation wey be like thief in the night, collecting back visas they already gave Nigerias. Not small people o, we’re talking about respected journalists, top agency heads, big business moguls, people wey nor even get wahala with immigration before.
Letter go just land: “Come to the embassy with your passport.” You reach there thinking they want to stamp you VIP upgrade, only for them to cancel the visa with straight face. No gist, no explanation, just one cryptic law number.
E shock so many as some only discovered at the airport. Just imagine you stand in line with your boarding pass, calculating how you’ll snap picture with Statue of Liberty, then immigration whisper: “Sorry sir, your visa is dead on arrival.”
Before you even say “God forbid,” you’ve already become motivational speaker for refunding flight tickets. Some even tasted small detention before being released like suspect wey no get case file.
As if America never do enough, UK too don carry loudspeaker enter the matter. Their Home Office dey send direct SMS like scorned lover: “Please pack your load once your visa expires, if not, we go personally escort you.” The way dem talk am ehn, you fit think say dem go arrive with moving truck come carry your Ghana-must-go. Students wey dey form asylum seekers, abeg una don turn UK to refugee camp?
But our Naija government, as usual, dey sip zobo like say nothing dey happen. No official word, no outrage, no follow-up. Just vibes. The embassy too just dey play deaf and dumb. Meanwhile, Nigerians with clean records dey stranded, no crime, no overstay, no wahala. Yet their visas don vanish like thief in traffic.
At this point, japa dream don dey resemble bad dream. America dey revoke like ex collecting back iPhone wey dem gift you, UK dey chase students like landlord chasing tenant wey owe rent. And Nigerians? We just dey here, calculating which country still get space for us before dem too join cancelation ministry.
