Southerner Xtra -Trending with Nancy Mbaegbu
Sunday, November 16, 2025
Abeg, Abuja no dey ever dull oo! On Tuesday, Minister of the FCT, Nyesom Wike, waka go one land site, but eu shock as soldier’s block am from entering like say na him be trespasser. The thing burst everywhere because who wan believe say minister go dey struggle pass gate like tenant wey landlord pursue?
Video wey circulate show Wike dey vex, dey scold him aides, dey push body like say him wan out–muscle army. One officer even dey make phone call like say na HQ him dey dial for reinforcement. Wike dey try to waka forward, but soldiers block am. Internet catch fire like generator coil.
Wike no gree hold body at all. The man shout: “This is unprofessional! You no fit face minister like this!” Na so tension begin climb like NEPA pole. Members of him convoy sef begin exchange hand and shoulder with military personnel.

But the naval officer, Lieutenant A.M. Yerima, no even shake. The guy stand gidigba like statue wey dem cement with pride, tell Wike: “Sir, I dey follow orders, I dey do my work.”
Wike, in full Port Harcourt energy shout back: “Shut up! You big fool! I dey school before you were born!” The officer coolly yan back: “I’m not a fool, sir, I have integrity”. At that point, Nigeria itself pause to drink cold water.
After social media don do autopsy of the fight from 59 angles, former Aviation Minister Osita Chidoka come drop him own hot take. The man say Wike suppose apologize, because disrespecting uniformed personnel no dey good for state authority. According to am, democracy get process, no be who shout pass.
Then gist twist again when people discover say Lieutenant Yerima na pikin of former Army Spokesperson, General M.M. Yerima. Omo! Respect upgrade instantly. Defence Minister Mohammed Badaru sef come yan: “The officer acted right. Anybody wey touch am go hear am. We go protect am.” Na there internet scatter finally.
Wike no keep quiet oo. The man address press men later and clarify say him no call military “fools. According to am, the “big fool” wey everybody hear no be insult to the Nigerian military, but to the illegality of the officer’s action. In his words: “I wouldn’t have said military is a fool. I know their rules. What I meant was you can’t be carrying out an illegal order.”
He even remind Nigerians say him dey always respect process, say even before him assume office, him don handle similar military related land wahala through proper channels without confrontation. Na there Wike begin drop name of people wey dey call am directly for help; Obasanjo, Danjuma, just to show say respect get levels.
But Wike no stop there. Him blast former Chief of Army Staff, General Tukur Buratai for saying his behaviour be national security threat. “He can’t teach me decency. This is the same man wey tell GOC to rig my election. He no fit rig me. He tried to kill me, I no die. Na polling agent him become later. Look at his level!”
At this point even microphone fear to fall.
Meanwhile, to avoid more embarrassment going viral, Wike come ban all AGIS staff below Grade Level 14 from carrying phones. Immediately, civil rights groups shout say the bandey primitive and na sign of paranoia in power. NANS join too, condemn Wike for verbally abusing the officer.
Now everybody get opinion like say dem be constitutional lawyers. Some hail the officer: “Correct man! No dey fear anybody even minister!” Others dey drag am: “Why you go block minister? You wan trend?” Internet turn to market oo. Everybody begin dey give opinion like dem be legal advisers.
But if una sabi Wike small, una know say this matter no dey end anytime soon. This one na only Episode 1. More drama go still drop. Abuja people, adjust your chair, carry popcorn, because this series never even start proper.
Unending drama of Regina Daniels, Ned Nwoko (Part 4)
My Aprokonation this Regina and Ned matter don turn movie series ooo, each week new gist, new confession, new episode of who go shame who pass. At this point, even the elders for Anioma go need data to keep up.
Just when we think say the matter don cool small, Uncle Ned carry him senator suit throw one bombshell for Instagram, and everywhere scatter again.
Early last week, Senator Ned drop video like lecturer wey come present “Evidence 101,” claiming say Regina brother, Sammy, dey terrorize him house like unpaid landlord. Ned talk say this same Sammy na him sponsor am for school, buy music instruments for am, even furnish house for Abuja join.
Ned no stop there o. Oga say in two years, him don send Regina mama, Madam Rita, ₦125 million! Na that part wey make social media freeze like, “Abeg who be your daddy, Ned?”
But the real thunder strike happen when him begin talk say Regina dey battle drug addiction. According to him, doctors say make they keep her away from her “enablers,” but her siblings and friends like Destiny, Sonia, and co dey sneak in with the same “stuff” she dey try quit.
Ned claim say Regina go dey high, skip food, and dey roam the house like spirit. One night, him say he catch her in his room high again, and when he told her to go, she say Sammy girlfriend dey her room.
From there, gbas enter gbos, Sammy stormed the mansion like action hero shouting, “Come down and face me!” Na so security push am commot. Ned even talk say Sammy don dey behave violently because of drugs.
Just when people still dey digest that shock, Oga continue with another episode say Regina dey disappear for night, ignore calls, return next morning dey talk say she go club.
He mentioned say one “Cassie” na her main supplier, and this Cassie dey stay for her Life Camp house. Ned say him just tire, that him don endure nonsense for the sake of the kids. But wait o, the real pepper? Himbsay Regina mama dey claim say doing drugs na celebrity lifestyle. My people, na from rehab we enter revelation.
Regina no gree o! The babe reply for Instagram with venom, capital letters, and heartbreak emoji. She start with: “YES! It is now in history that Regina Daniels did drugs because that’s what her husband wanted!”
She called Ned a “narcissistic manipulative bastard,” said he used her, lied, and even got her sextape which she prays never leaks. She remind am say she marry am at 17, and she thank God for time wey open her eyes. She talk say her name don spoil for now but she go rewrite her story. Madam say she’s ready to fight in court with full chest, and no going back.
Then she scatter the table entirely; say Ned dey lie about her family because he wan isolate her, make she get nobody to run to. She admit say she did drugs, but only because Ned encouraged it, claiming he used to tell her she’s “sexier when high.”
Regina even accused him of forcing himself on her when she said no, seizing her phones, locking her up, and bringing doctors to inject her with “mental illness drugs” anytime she challenged him. She say no legal marriage even exist sef, that they never signed court papers “so Oga, stop acting like you own me!”
Before anybody fit breathe, her brother Sweezy enter the chat like street lawyer. The boy clap back: “Oga Ned, post where you sent me $75k abeg.”
Sweezy boast say him don build three houses, drive cars pass Ned’s kids, and called Ned a manipulator chasing fake fame. Him drag am like generator wire say the same Sammy wey campaign for Ned’s election and deliver votes suddenly turn drug supplier? “Abeg rest!”
He even dropped a voice note of Ned saying he can slap his wife anywhere, even in the UK, and court go still take his side. Sweezy say, “Make you call am AI voice note, I go drop part two.”
As if family drama never full basket, Ned’s alleged brother, Chuks Nwoko, come outside too. My people, that man no send anybody. Him say Ned dey disgrace the Nwoko family and he’s reaping what he sowed.
Chuks claim say Ned no even dey as rich as him dey package, that the family once supported him through school, and he’s now using power to oppress. He quote Bible join say Ned need to repent because shame don reach home. Even family don join the drag.
Before internet even cool, activist Omoyele Sowore jump in with microphone: “This no be politics again o! If Regina truly marry Ned at 17, that’s a case of abuse and statutory rape.”
He called for investigation, saying Ned should be held accountable, even in the UK where he still dey practise law. The man talk say impunity get expiry date, and Ned’s time don reach!
Now everywhere don turn tribunal. Some people dey shout “Regina, sue him!” Others dey blame her mama, say parenting don fail.
One person even drop philosophical thread: “Just because your child is the breadwinner doesn’t mean you hand over parenting like remote control.” Social media no get peace again, half of Nigeria don turn family therapist.
But finally, amidst all the drama, small good news don drop, dem don grant Sammy bail oo of N5 million. At least person fit breathe small now. Whether this go calm the storm or spark another episode, we never know.
When we think say we go rest small as dem don bail Sammy, drama dey one side dey look us with side-eye. Because before anybody fit sip water drop cup, Ned Moroccan wife, Laila, burst online like woman wey don swallow truth serum.
She ask Regina, “How dare you say you ever gave me money, for what exactly?” She claim say she’s very content with what her husband provides, and even suggest make dem both show Nigerians their bank accounts.
From there, she begin spill plenty tea say Ned hate alcohol, drugs, and smoking, and the main reason Regina dey fight am now na because he wan make her stop her addiction.
Laila no stop there. She reveal say six years ago, Regina na the one wey introduce her to drugs, and she for don lose her marriage if not for Ned’s quick intervention.
She talk say since Regina enter that family, she turn bad influence; giving drugs to nannies, workers, and even her younger sister Destiny. She even claim say Regina dey sleep with almost every girl around her and that she can’t trust her daughters near her unsupervised.
The woman end am like pastor wey drop final warning: “Please go and seek help and continue with your rehabilitation, and leave the other wives out of this.” My people, this one no be clapback again, na full-blown character demolition.
Before Nigerians even digest this new revelation, Ned himself jump in again! Oga Senator carry another statement come out like man wey dey defend project.
He said all this talk about Regina being 17 when he married her na pure lie. According to Ned, when he met her, she tell am say she be 21, and she even show her INEC voter’s card born October 10, 1998. He claimed say him still hold the card till today as evidence.
Ned break am down say their marriage don last six years, so Regina should be 27 now. And then he dropped the final punchline say make Nigerians take Regina claims with caution, considering her “current mental condition” after abandoning rehab.
But before now, Senator Ned Nwoko don already issue official statement through his Communication and technical action team, saying all these recent stories about him and Regina na politically motivated gist wey people dey use to tarnish his image.
Him talk say Regina Daniels, born on October 10, 2000, marry am at 19 not 17 as people dey claim, and that her mama personally bring her for the traditional marriage, say him no even pursue her. Abeg Senator which one we go believe now?
Omo this gist don pass couple quarrel. The whole thing don turn full blown dynasty war. Every week, new evidence, new cry, new confession and internet just dey sip tea in slow motion.
Marriage no be by force, because with this kind gbas-gbos wey don stretch for weeks, e don pass husband and wife wahala, na full-blown generational vendetta. And as usual, social media go still pick side. But One thing sure be say, this gist never near the end, e just dey warm up. Stay tuned for part 5
Lagos socialite Pretty Mike lands in hot soup

My people, just when we still dey recover from the NDLEA midnight invasion for Proxy Nightclub that turned Victoria Island into crime scene of the year, court don finally drop hammer on the matter and it is loud.
So, according to latest tori, Federal High Court for Lagos don order interim forfeiture of Pretty Mike’s nightclub over heavy drug allegations.
As in, NDLEA talk say the man’s beloved Proxy Nightclub for Akin Adesola Street Lagos state no just dey serve cocktails and afrobeats, e dey serve small laughing gas buffet join. Dem say 169 cylinders of nitrous oxide and 200 grams of special greens were discovered during the October raid wey scatter the whole nightlife.
The agency yarn say dem even catch wind of a planned large-scale drug party; see as e sweet for grammar but bitter for gist. Na so NDLEA storm the place like Netflix SWAT unit, arrest over 200 people wey just dey dance “Unavailable” in peace.
After dem test the materials, lab result come confirm say e no be ordinary gas and leaf, na the controlled type wey go make government frown. Based on all this evidence, Justice Musa Kakaki no even blink, he ordered that the entire nightclub be temporarily seized by the Federal Government.
Meaning say Proxy Lagos don officially turn government property until further notice. As in, club lights off, music mute, champagne dry, and all operations suspended till January next year when dem go continue the hearing.
But wait, e never finish. Pretty Mike himself and his club supervisor, one Joachim Hillary, don also face arraignment for court. Both of them plead not guilty, and as usual, senior lawyers don show face to defend with grammar and prestige.
After back-and-forth argument, court finally grant Pretty Mike N50 million bail, plus two sureties wey must swear affidavit of means; meaning person wey wan stand for am must get money wey pass vibes and insha Allah.
For now, Pretty Mike don regain temporary freedom, but Proxy Lagos still dey under lock and key. The next hearing go happen January 14, 2026 and Nigerians don already dey countdown for the continuation of this gist.
